2 Aug 2014

IBO BOY LIKE ME NA HIM ORDINARY CONDUCTOR WAN CHEAT

There is one thing I like in my life.....and dat is CHEATING! see, wen I say cheating...I dnt mean husband-wife tinz o. dat one no concern me. The kind of cheating I mean is wen you cheat me money-wise.... *chai* I fit kill person for dat kind cheating.
 Make I tell una wetin hapun to me yestday.

My galfrnd wey dey live for Oshodi area call me say make I come visit am.  i baff up, kit up come steal perfume spray. Mehn, I don set die. Na I'm I board Danfo bus from Iyana Ipaja. As I enta I ask d conductor say how much from Iyana Ipaja to Oshodi and he talk say na #50. I no complain. I sit down pay the money...come dey imagine how I go take kiss...and *coughs* u knw d remainin ting na.

As I jus dey do my imagining tinz, na him my brand new Bold 2, ring. O boy na my boss wey dey live for near Airport ooo. He ask me say where I dey and I tell am say I dey iyana ipaja...(Na dere I fuck up) He just talk say make I cum meet am for Ikeja bus stop. Ah! See me see gobe! My Oshodi babe go need to wait o. Na him I face conductor.

Me: oga conductor am not going to Oshodi again, cos I will drop at ikeja
Conductor: ok
Me: shebi, iyana ipaja to oshodi na #50? Since I no drop for Oshodi again my money suppose reduce to #30?
Conductor:  iyana ipaja to oshodi #50.... Iyana ipaja to ikeja, #50...


Wat!!! Na me dis conductor wan cheat? Ibo boy wey get sense like me? God forbid.

Wen we reach ikeja, he talk say make I come down... Me? Lai lai... I no gree o. Na so my #50 go WASTE??? I no come down ooo!

I SIT DOWN FOR THE BUS.....ENJOY MY MONEY FROM IKEJA reach OSHODI...

Wen I come get down for OSHODI after enjoying my money, ......... .......
............ I COME TREK FROM OSHODI BACK tO IKEJA TO See my BOSS!!!

At least enjoyed my fifty naira. Make una no mind the conductor wey wan cheat me.


Abi shey I no do am well??? or wat do you think?

No comments:

Post a Comment